You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
NLC Strike: Buhari don agree for N30,000 minimum wage - APC
Nigeria Presido Muhammadu Buhari on Tuesday gree make workers for di kontri dey begin collect thirty thousand naira as Minimum wage.
Buhari tok say e go send bill give di National Assembly on top di mata.
Di three group committee dem wey join review di National Minimum wage recommend give Preisdent Buhari on Tuesday say make goment begin dey pay N30,000 as di new minimum wage for workers for di kontri.
As soon as di presdo agree di new minimum wage wey di committee present, na so Nigeria ruling APC politic party enta twitter make di announcement.
President Buhari receive di report from di chairman of di committee wey be di former Head of Service of di kontri Ama Pepple for inside di presidential villa for Abuja.
E thank di committee members for dia effort ontop di mata come promise dem say e go send di executive bill go National Assembly make dem stamp am.
Di president also draw ear give workers dem make dem no allow pipo wey dia way no pure use dem.