NLC Strike: Buhari don agree for N30,000 minimum wage - APC

Buhari, Labour Minister Chris Ngige and One Nigeria govnor Bagudu of Kebbi State
Wetin we call dis foto, Buhari, Labour Minister Chris Ngige and govnor Bagudu of Kebbi State
Read am in 1 mins

Nigeria Presido Muhammadu Buhari on Tuesday gree make workers for di kontri dey begin collect thirty thousand naira as Minimum wage.

Buhari tok say e go send bill give di National Assembly on top di mata.

Di three group committee dem wey join review di National Minimum wage recommend give Preisdent Buhari on Tuesday say make goment begin dey pay N30,000 as di new minimum wage for workers for di kontri.

As soon as di presdo agree di new minimum wage wey di committee present, na so Nigeria ruling APC politic party enta twitter make di announcement.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

President Buhari receive di report from di chairman of di committee wey be di former Head of Service of di kontri Ama Pepple for inside di presidential villa for Abuja.

Muhammadu Buhari dey collect report from Ama Pepple

Wia dis foto come from, Garba Shehu

Wetin we call dis foto, Muhammadu Buhari dey collect report from Ama Pepple

E thank di committee members for dia effort ontop di mata come promise dem say e go send di executive bill go National Assembly make dem stamp am.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Di president also draw ear give workers dem make dem no allow pipo wey dia way no pure use dem.