You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Fayose: EFCC still dey hold di former govnor afta court postpone case
Ayo Fayose, di former govnor of Ekiti state, southwest Nigeria, go know by Wednesday if Judge for Federal High Court for Lagos go gree make dem bail am from detention.
Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) carri oga Fayose go court today say im use kurukere hand collect illegal $5million from former defence minister, Musiliu Obanikoro, wey im use for Ekiti election in 2014 and ten more charge dem.
But Fayose tok say na last Friday im first hear dem go drag am go court for Lagos and im lawyer don file permission for bail wey judge say na right Fayose get.
Mr Fayose don deny all di accuse wey EFCC nack for im head and on Friday, 19 October, e rub pepper for dia eye say make dem carri am go court.
Na for Twitter Oga Fayose nack yan say since di anti-corruption police dey claim say dem get prove case of wayo against am, why dem dey slack.
Fast forward to Monday morning, 22 October EFCC drag Fayose go face court for Lagos on top 11 count charge.
EFCC say oga Fayose get hand inside different offense of mago mago wey begin for 2014 wen im become govnor for di second time.
Some of charge include:
End of Di one wey oda users dey read well well
- Charge 1: Im collect money wey no pure of up to N1,219,000,000 (One Billion, Two Hundred and Nineteen Million Naira) wey im use sponsor im own govnorship election for Ekiti in June, 2014
- Charge 2: Im collect cash money wey no pure of up to $5,000,000 (Five Million Dollars) from former Minister of State for Defence Senator Musiliu Obanikoro in June, 2014
- Charge 3: Im keep N300,000,000.00 (Three Hundred Million Naira) for fixed deposit bank account wey no follow law
- Charge 4: Togeda wit Spotless Ltd. and members of im family dem dey control N317, 000, 000.00 (Three Hundred and Seventeen Million Naira) for one local bank
Dis na big reverse for Mr Fayose wey until last week Monday, na im be di govnor of Ekiti state till im step down for new govnor Dr. Kayode Fayemi.
Fayose na di last Peoples' Democratic Party (PDP) govnor among di south west Yoruba states and im use im voice oppose di goment of President Muhammadu Buhari.