Fayose: EFCC still dey hold di former govnor afta court postpone case

Ayo fayose inside Federal High Court, Lagos
Read am in 2 mins

Ayo Fayose, di former govnor of Ekiti state, southwest Nigeria, go know by Wednesday if Judge for Federal High Court for Lagos go gree make dem bail am from detention.

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) carri oga Fayose go court today say im use kurukere hand collect illegal $5million from former defence minister, Musiliu Obanikoro, wey im use for Ekiti election in 2014 and ten more charge dem.

But Fayose tok say na last Friday im first hear dem go drag am go court for Lagos and im lawyer don file permission for bail wey judge say na right Fayose get.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Mr Fayose don deny all di accuse wey EFCC nack for im head and on Friday, 19 October, e rub pepper for dia eye say make dem carri am go court.

Na for Twitter Oga Fayose nack yan say since di anti-corruption police dey claim say dem get prove case of wayo against am, why dem dey slack.

Fast forward to Monday morning, 22 October EFCC drag Fayose go face court for Lagos on top 11 count charge.

Mr Fayose and im lawyers bin want make di court order bail

EFCC say oga Fayose get hand inside different offense of mago mago wey begin for 2014 wen im become govnor for di second time.

Some of charge include:

  • Charge 1: Im collect money wey no pure of up to N1,219,000,000 (One Billion, Two Hundred and Nineteen Million Naira) wey im use sponsor im own govnorship election for Ekiti in June, 2014
  • Charge 2: Im collect cash money wey no pure of up to $5,000,000 (Five Million Dollars) from former Minister of State for Defence Senator Musiliu Obanikoro in June, 2014
  • Charge 3: Im keep N300,000,000.00 (Three Hundred Million Naira) for fixed deposit bank account wey no follow law
  • Charge 4: Togeda wit Spotless Ltd. and members of im family dem dey control N317, 000, 000.00 (Three Hundred and Seventeen Million Naira) for one local bank
Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis na big reverse for Mr Fayose wey until last week Monday, na im be di govnor of Ekiti state till im step down for new govnor Dr. Kayode Fayemi.

Fayose na di last Peoples' Democratic Party (PDP) govnor among di south west Yoruba states and im use im voice oppose di goment of President Muhammadu Buhari.