EFCC don rubbish voice recording wey claim say Fayose go die for dia hand

Wia dis foto come from, Lere
Nigeria corruption police, EFCC on Thursdayalert di public about one voice recording wey pipo dey share upandan for social media say dem go kill former Ekiti State govnor Ayodele Fayose if im no confess say e chop money.
Di Economic and Financial Crimes Commission say di voice recording na di handwork of jaguda pipo wey wan turn dia attention to oda tins from dia investigation on top corruption charges against Oga Fayose.
For inside di audio wey leak on Wednesday for Social Media, di former govnor dey tell EFCC say "dem no go fit force am to tok wetin im no wan tok"
Im also accuse di EFCC say dia mission to investige am na to "bring am down," but im believe in "fair hearing for court as e no dey fear di way dem dey intimidate am."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
But di EFCC deny all dat tok for tweet on Thursday say even though di audio tape no show wia di conversation happun between Fayose and dia oga Ibrahim Magu, make di public no take di tape serious.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Fayose bin show face for Economic and Financial Crimes Commission office inside Abuja on Tuesday afternoon to submit imsef to Nigeria corruption police.
Di former govnor dress like guy man, wear T-shirt wey dem customize "EFCC I'm Here" wit jeans and face cap march go dia office wit Rivers State govnor Nyesom Wike and Nigeria fomer Minister of Aviation Femi Fani-Kayode.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post






