James Ibori lose appeal against UK court to cancel im ex-convict case

Wia dis foto come from, METROPOLITAN POLICE
Former Delta State govnor for southern Nigeria James Ibori don lose im appeal for UK court to free am from accuse say e kolobi plenti money wen e bin be govnor.
Oga Ibori bin spend time for UK cell afta im plead guilty to launder nearly $65m for 2012.
Tori be say three appeal judges dismiss di case as dem no fit proof di accuse from Ibori say di police officer dey corrupt.
For December 2016, dem release am and deport am to Nigeria afta im serve half of im 13-year sentence for prison.
Di former Delta State govnor appeal against di accuse and im even allege say police officer wey investigate am bin dey corrupt too.
Wen dem bin arrest am, Ibori bin dey in di process to buy $20m private Jet.







