Cameroon Appeal Court adjourn case for Sisiku Ayuk Tabe, odas for November

Sisiku Julius Ayuk Tabe

Wia dis foto come from, Sisiku Julius Ayuk Tabe/Twitter

    • Author, Leocadia Bongben
    • Role, BBC News Pidgin, Cameroon
  • Read am in 2 mins

Southern Cameroons leader, Siskiku Ayuk Tabe and nine odas no show for court for seka say administrative procedures no bi complete so deh adjourn de case for November 1.

"We kam dis morning we see de magistrate e tell we say e bi don forget, say magistrates get meeting make we wait afta de court go start", Barrister Christopher Ndong tori BBC News Pidgin.

"So we leave, ten minutes afta deh call we say court wan start, but to we surprise deh no bring deh pipo dem again for court", e add.

Skip Facebook post

Content is not available

View content on FacebookDe external site no concern BBC.

End of Facebook post

Deh lawyers bin appeal because de pipo no be appear for court and deh question court why deh wan start again weh deh pipo dem no kam for court.

Law say deh no fit judge case weh de client no dey, so de defence counsel ask de state counsel make e tok why de accused no no kam for court.

De state counsel say e bi don already make e production warrant, depositam for gendarmerie weh deh di carry out investigations.

De colonel weh e bi in charge of the investigation kam court say na for morning e di hear say make e bring de pipo Sisiku dem.

But e no bi fit bring dem because e need administrative formalities before e bring dem.

E beg de court make de adjourn de mata so next court sitting e go bring Sisiku and odas for court.

"Weti we expect today na for make de leaders appear before de court", Barrister Ndong tok.

"For last court session we tell judge say de reason weh we file appeal na because lower court bin violate de procedure for criminal procedure code.

Da code di tok about special proceedings under "Habeas Corpus", weh e mean 'bring de bodi'. Dis mean say deh violate some man e rights and now we say bring de dodi make we judge him",

E argue say lower court bin pass decision weh deh no bring dem for court, and deh file appeal". Ayuk Tabe lawyer tok.

Barristers John Fru Nsoh and Christorpher Ndong na Sisiku dia lwyers
Wetin we call dis foto, Barristers John Fru Nsoh and Christorpher Ndong na Sisiku dia lwyers.

De first day for court hearing, deh lawyers file objection, tell de judge say de same tin for lower case don di happen and dem as defence for Ayuk Tabe bin say deh no fit tok weh dia clients no dey for court.

Deh argue say procedure for 'Habeas Corpus' mean say de pipo get for bi present and deh ask court for bring dem today.

Deh bin adjourn de case so dat de legal department and de court go do averi tin for make sure say deh pipo appear for court.

If dey no appear court go explain why, Barrister Ndong tok.

Sisiku Ayuk Tabe and odas dey for State Secretariat for Defence, SED cell since January 25 weh deh force dem back for kontri from Nigeria.

Deh bin arrest Sisiku Ayuk Tabe and nine odas for Nera Hotel and with odas weh goment arrest for Nigeria na 47 Southern Cameroons deh force back for January.