Cameroon secessionist leader dem dey Yaoundé?

Wia dis foto come from, @GovAmba -Twitter
Tori dey for ground say secessionist leaders dem deh Yaoundé since Friday 26 January, as TV Channel, France 24 tok.
Cameroon secessionist leader dem de Ongola? Dis question dey for pipo mop for Cameroon.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
Some pipo di doubt, some believe dis tori, but government tok-tok person Issa Tchiroma Bakari nova tok.
Source for Southern Cameroon group still di tell BBC Pidgin say no be true de tori say dia leader dey Yaounde.
Na for 5 January, wey tori komot say Julius Sisiku Ayuk Tabe and e 11 kombi di miss for Nigeria.
Den after de discovery say na Nigerian security agents dem bi take dem from dia meeting place for Nera Hotel for Abuja.
All eye dey na for Yaoundé now for see de secessionist leader dem how wey tori say deh dey Ongola._________________






