President Nana Akufo-Addo: We dey inside difficult times for Ghana, but e no sheda be crisis

President Nana Akufo-Addo for di first time admit say Ghanaians dey inside difficult times sake of di challenges for di economy inside.

But he add say despite dis reality, Ghana no sheda dey in crisis situation.

He make dis revelation to di Ghanaian community who dey New York, USA, where President Akufo-Addo admit say di increase in crude oil prices den di rapid depreciation of di cedi be di cause, something which di Bank of Ghana dey deal with.

"We for approach di foreign exchange matter medium to long-term by expanding wanna supply base, that no be crisis. E be difficult times wey dey go through now, difficulties wey di system go fit accommodate," President Akufo-Addo reveal.

But government no dey slack as dem dey try find solution to give Ghanaians he add.

Last week fuel stations for Ghana start dey sell fuel one litre for GHC 5 Cedis ten pesewas after di Bulk Oil Distribution companies (BDCs) pass on a hike in cost of fuel to Oil Marketing Companies (OMCs) who also push am on consumers.

Dis bore chaw Ghanaians who dey demand action from di President as di fuel matter, together with di cedi depreciation dey make life difficult give dem.