You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigerian Traders protest go ECOWAS to make Ghana open back dia shops
National Association of Nigerian Traders (NANTS) carry 'we no go gree waka' go ECOWAS secretariat and Ghana high commission wey dey for Abuja, Nigeria to complain about di way Ghana dey close shops wey belong to Nigerians inside dia kontri
Di President of NANTS, Barrister Ken Ukaoha, tell BBC Pidgin say ECOWAS vice president na im receive dia petition on behalf of di Commission and promise to contact Ghana Authorities plus settle di mata shaperly.
"Di vice president also sympathize wit NANTS over dis palava wey include di closing of Nigerians stores for Ghana".
"And im also sympathize wit di association on top one of our member wey kill imsef because her business wey dem close for Ghana, wey be her only hope to feed".
Di 'we no gree waka' cause serious hold up along Asokoro area for Abuja today as di protesters march through di streets of Yakubu Gowon way inside Asokoro.
Dem carry placards wey dem for write different tins wey dem want like; "Nigerian trader for Kumasi don commit suicide out of frustration", "ECOWAS, we no go gree for wetin dey happen to Nigerians for Ghana", "Ghana wants AfCTA secretariat but dey deal wit African traders" and odas.
According to local report, Bar Ukaoha say wetin dey happun for Ghana don bad well-well sotey dia parliament recently pass law wey go make di business environment hard for foreign investors.
E say since Ghana dey among ECOWAS law wey concern free movement of goods and services, e go go good make ECOWAS draw ear give Ghana goment.
End of Di one wey oda users dey read well well
How dis palava take start?
Dis mata start for 2007 and draw like ogbolo soup come reach today.
But di tension come increase wen Ghana arrange law wen say dem no go allow any foreigner to do business for di kontri unless im get one million USD in cash or equity.
And den for August 2018, wen tori comot say Ghana authorities bin arrest and detain 37 Nigerian traders wey dey work for Ghana and also lock ten shops for Kwame Nkrumah Circle afta one inspection.
Secretary-General of di Nigerian Union of Traders Association of Ghana, Comrade Everistus Nwankwo, react say Ghana goment no even give dem notice before dem land, and im ask why e be say dem no enter shops wey belong to Senegalese or Togolese, say na "Nigerians dem come target".