You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chimamanda Adichie say pipo don turn bride price to wetin dem dey use make money
Nigerian ogbonge writer Chimamanda Adichie don enta to break internet again as she bride price for Africa don turn to way to make money sotay e dey turn belle.
For one event "An evening with Chimamanda", wia young pipo bin dey ask questions about her writing and her fight for feminism, she say bride price dey give men feeling say dem own di woman afta dem am.
She say for di olden days marriage bin dey different as na even afta di bride family don collect bride price, di family go give sometin to di groom family too. So no be sale, na exchange.
"I tink say if you look history, di idea of marriage dey different to wetin dem dey do today. Yes, bride price bin dey wia dem dey give tins to di bride family, but di bride family dey also drop for di groom family."
"Now, e be like na to make money na di whole idea, and e dey disgusting to me", she tok.
She also tok about writing and African culture, feminist mata and also explain wetin she dey tok for di Trevor Noah interview about holding doors for women.
Pipo for social media comot but dem no criticize dis current tok as dem don do her former ones.
Pesin say make she start to dey write books again.
End of Di one wey oda users dey read well well
Dis pesin wan make pipo start to dey rethink di mata true-true.
Dis pesin get im own idea.
Dis pesim wan know if Chimamanda tell her pipo make dem no collect bride price and wetin dem tok.
Pesin dey try understand if dem dey train female children to sell dem.
For di event, "An evening with Chimamanda", she tok say she neva sure when she go write her next book even as she start to dey break table on top culture and gender.