You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Chimamanda Adichie don tok enta Cameroon Anglophone crisis
Ogbonge award wining Nigerian writer Chimamanda Adichie don write about di crisis wey dey burn for di Anglophone regions, northern area of Cameroon.
Fight-fight for Cameroon burst since 2016 wen di English speaking pipo for di Anglophone area start to dey ginger to comot di kontri based on marginalisation and some oda dealings wey no favour dem.
According to Adichie, wetin dey happun na because Africa no get regard for e minority.
Adichie tok her mind through di tori wey she write about her Anglophone Cameroonian friend wey e name na Theo. She trace di history of di kontri, and also tok about her mama parents wey bin dey do bizness for di old British Cameroons.
Five tins wey Adichie tok
- Adichie tok say tori pipo dey call wetin dey happun 'Anglophone crisis' and dis one no torchlight how serious di mata be as hundreds of pipo don kpai ontop di mata
- According to Adichie, di koko of di mata no be about language but na di fact say di kontri dey disregard di minority for di kontri. She say di crisis na also about di way wey European colonialism cause kasala.
- Adichie say her friend Theo believe say French presido Emmanuel Macron visit Nigeria to join bodi wit Nigeria forces to fight Anglophone
- say if dem born you as Anglophone for Cameroon na big issue, as di Anglophone wey make up 20% of di population dey struggle to learn French while di Francophone pipo dem no send English at all
- Anglophone children dey hear am for school ontop di hand of dia Francophone teachers wey dey teach dem wit French and flog dem if dem complain say dem no understand.