Ras Kimono: Efe Kimono, wife of di late musician don die

Read am in 1 mins

Three months after di death of Nigerian reggae singer, Ras Kimono, im wife, Efemena 'Efe' Okedi, don die for Sunday, 23 September, 2018.

Di family never comot to officially announce di informate about di death of dia first lady but tori be say she die for early morn morn on Sunday for her Magodo Isheri house for Lagos.

BBC don try to reach Ras Kimono pikin, Oge for phone but di call no enta.

Efemena put am for her Facebook page say her work na Personal Assistant (P.A) for Massive Dread Organization.

Ras Kimono, wey im real name na Oseloke Augustine Onwubuya die at di age of 60 on 10 June, 2018, small time afta im do big parti with celebrities for im birthday.

Ras Kimono bin popular wella wit hit songs like; 🎵'Ayaga Yaga Yaga Yo oho...'🎵, 🎵'Under Pressure'🎵, 🎵'We No Want'🎵and all im song dey tok about how kontri man dey suffer.

Im don win awards boku wey include Nigeria Music Awards and Fame Music Awards.