Ras Kimono: Nigeria reggae star don die

Read am in 1 mins

Nigerian reggae artiste Ras Kimono don die.

Di 60 year old reggae artiste wey im real name na Ukeleke Onwubuya die for Lagos on Sunday afternoon.

One close friend of Ras Kimono family na im confam di singer death give BBC Pidgin.

Tori be say e slump on Friday, dem rush am go one hospital for Lagos before e die on Sunday.

'No bodi fit tok now' na wetin pesin wey answer im wife Efe Kimono phone, tok wen BBC Pidgin call to know how e die.

Ras Kimono bin popular wella wit hit songs like; 🎵'Ayaga Yaga Yaga Yo oho...'🎵, 🎵'Under Pressure'🎵, 🎵'We No Want'🎵and all im song dey tok about how kontri man dey suffer.

Im don win awards boku wey include Nigeria Music Awards, Fame Music Awards.

As tori of im death land pipo begin tok about di Asaba born singer for social media.