This is Nigeria: Falz say pipo need see di bigger issues wey dey society

Falz bin no expect say im political video "This is Nigeria" go catch fire di way e do for Nigeria plus di whole world.

E hot sotey Muslim Rights Concern (MURIC) vex tok say make di singer comot di video because some girls dey use hijab dance Shaku Shaku. Say if e no do am, dem go carri am go court.

Falz siddon wit BBC News Pidgin to yan about wetin im feel say musicians suppose do for society.