Skye Bank customers - Four tins you need to know about your money

Skye Bank office

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Skye Bank na one of di new generation banks for Nigeria

Central Bank of Nigeria don reply give customers of Skye Bank wey wan know wetin go happun now wey dia bank don change to Polaris Bank overnight.

Like play like play, Skye Bank - wey be bridge bank for Mainstreet Bank some years back - no exist again as Polaris Bank don take over dem, according to order from CBN.

Pipo wey get money for di bank go wan know wetin dis change mean for dem and CBN inside official statement wey director Godwin Emefiele sign, say customers get notin to fear.

CBN want Skye Bank customers to know say:

  • Dia money dey safe for di new Polaris Bank
  • Bank go open norma norma from Monday 24 September
  • Dia information and records no go change inside di new bank
  • Di board, management staff and all employees of Skye bank go still remain
CBN official statement

Wia dis foto come from, Central Bank of NIgeria

Wetin we call dis foto, Di official statement wey CBN comot also tok about why dem withdraw Skye Bank licence