Tanzania ferry disaster: 100 pipo die wen boat somersault for Lake Victoria and di number go increase

Officials say di number of death fit reach 200

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, Officials say di number of death fit reach 200

At least 100 pipo na im don die afta one boat somersault for Lake Victoria for Tanzania, east Africa and di final number of pipo wey die fit reach up to 200.

Tanzania Police Inspector general, Simon Sirro wey confam dis informate to tori pipo also tok say dem don rescue 37 pipo but dem dey for critical condition.

BBC tori pesin, Anne Soy tok say as e be so, dem no know di total number of passenger wey enta di boat but officials dey yan say na over 400 pipo fit dey inside di MV Nyerere boat before e get accident.

Local media dey report say di number of pipo wey di boat suppose cari na 100 but e cari multiplied by three wen di accident happun.

Report say di MV Nyerere boat bin get wahala for wata wen passengers begin move go one side as e wan park for port.

Search and rescue operation still dey happun for Lake Victoria afta di boat back flip inside di river on Thursday close to Tanzania wata.

Tori pipo say di ticket seller dey amongst those wey kpai so di boat passenger book wey e record di total number of passengers don lost.

Tanzania don get different boat disasters recently. For 1996 like eight hundred pipo die for one single accident wey be one of di worst for di last 100 years.