Nigeria flood 2018: Na di same flood water we dey use cook - Flood victims

Children dey wash plates ontop flood water

Wia dis foto come from, Other

Wetin we call dis foto, Di flood destroy pipo house for Gundu, many of dem dey IDP camp now
    • Author, Dooshima Abu
    • Role, BBC News Pidgin, Abuja
  • Read am in 2 mins

For di past two weeks, flood water don scata many communities for Niger State, north central Nigeria.

As if say di pipo wey don die for di flood and property wey loss neva do, na still di same flood water some pipo dey use for drink, baff and even cook.

Di disease wey fit spread through dat kain dirty water, don claim e first life.

Sehidu and im wife Hawal still dey cry afta dia three year old pikin die for Egagi village for Lavun local goment area. Doctor bin tell dem say na cholera kill dia pikin.

Wetin we call dis Video, Nigeria flood 2018: Na di same flood water we dey use cook - Flood victims

Sehidu say afta flood water destroy dia domot and evritin wey dem get, dem come manage escape go meet dia neighbour but because dem dey drink and cook wit di flood water, dia pikin come catch cholera and e die for hospital.

"For di past 19 days we don cari am go hospital more than three times. I suffer well well and e break my heart as im die," na so she tok.

Flood dey happun evri year for Egagi village and as BBC reporter Dooshima Abu enta town, she see women dem dey wash dia plate, cloth and even baff inside di flood water.

Plenti of di pikin no go school wey just resume, instead dem dey swim inside di dirty water.

Niger state flood

Victims dey fear say disease fit brekete

E don reach hundreds of pipo wey di flood pursue comot from dia domot and many of dem don pack go live wit oda family members.

One of dem na Ndeji Hawa wey tell BBC say more than 20 pipo dey sleep for one room and say most of di pikin dem don catch cough and oda diseases.

"We no get beta water to use cook or drink and if we wan cook, we go boil di flood water and use am," she tok.

She say dem want goment to come helep dem.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Pipo dey tok say dem dey fear if tins kontinu like dis, dia pikin dem life go dey at risk.