Nigeria flood 2018: Goment don give assurance to helep pipo wey flood don affect

Wia dis foto come from, Getty Images
Nigeria President Muhammadu Buhari don order all federal goment agencies make dem use dia power to helep pipo wey flood don affect.
Na oga for di National Emergency Management Agency (NEMA), Engr. Mustapha Maihaja cari dis order come from state house for Aso Villa, Abuja.
Oga Buhari say make NEMA join hand with oda federal agencies on top di emergency operation for di kontri as flood dey hama different states but na oga Maihaja go dey in charge.
Presido Buhari drop warning say make NEMA report any agency wey no cooperate to helep victims.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
Dis dey come afta NEMA declare national disaster for Kogi, Delta, Niger and Anambra states sake of wetin flood don do dem.
For Monday, tok tok pesin for NEMA, Sani Datti say dem still dey torchlight eight oda states flood fit affect wey include; Taraba Adamawa, Kebbi, Edo, Rivers, Benue, Bayelsa and Kwara states.