Nigeria flood 2018: Schools wey just open for Orashi region for Rivers state fit close sake of flood

Wia dis foto come from, Iziadu Emmanuel
Flood dey make authorities consider weda dem go close some schools wey just open for di tear rubber school calendar as di flood don enta many schools for di area.
One woman for Akinima for Ahoada west local goment don die afta her canoe somersault wit di cassava wey she load inside, and as she no sabi swim, she drown.
Pipo wey get farm say na dive dem dey dive to harvest dia cassava and oda food wey dem plant as di water from di Orashi river don cover evri wia.
Rivers follow seven oda states wey NEMA dey torchlight say dem fit suffer heavy flood. NEMA don already declare national disaster for four states wey include; Anambra, Delta, Kogi and Niger.
South south zonal oga for di National Emergency Management Agency (NEMA) Ejike Martins tell BBC Pidgin say from today, NEMA don organise emergency operations centre for Yenagoa wey go handle evritin wey concern flood mata for Bayelsa and Rivers State.
Ejike say di emergency operations centre dey like headquarters wey go collect all work wey concern di flood response and one Yakubu Suleiman na im go dey in charge of di Bayelsa office.
Ejike tell BBC Pidgin say, ''All di work wey NEMA dey do as e concern relief materials, relocation of pipo to safe area, community sensitisation and odas, na dis centre go handle am and dem get full support staff."
Di NEMA oga say dem no fit do anytin about di flood but wetin dem fit do na to support pipo wey di flood don affect.
End of Di one wey oda users dey read well well










