You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Nigeria 2019 election: Yakubu Dogara no buy nomination form from APC
Yakubu Dogara, di Speaker for Nigeria House of Representatives, don pick 2019 election nomination form to return back to di House but no be from di ruling All Progressives Congress APC, according to wetin BBC News Pidgin find out.
Nigeria local tori pipo dey report say na under di platform of Peoples Democratic Party (PDP) im buy form.
'Dogara no buy form at all-at all from di party by di time of Wednesday deadline', one spokepesin for di ruling APC tok.
Tori be say Dogara wey neva tok say im don port comot from APC, pick im re-election form on Wednesday night come post dis message for twitter.
For one interview wit BBC, one member of PDP wey no want make dem mention im name, tok say true-true Dogara don join dia party.
Di pesin tell BBC say oga Dogara waka come collect di form Wednesday night but because e neva tok anytin for public about di form, na im make dem too keep quiet.
Di speaker pick di form a day afta plenti of im constituents travel go Abuja from im home state wey be Bauchi.
APC spokespesin, Yekini Nabena tell one local tori pipo say dia party no dey surprise for wetin Dogara do because dem already know say he don dey work wit di PDP.
End of Di one wey oda users dey read well well
Oga Dogara first enta parliament for 2007 as member of PDP, from 1999-2015. E later join some PDP we vex leave di party go form APC for 2014.