Why di ban on fake nails, eye lashes dey provoke women

Di hot topic wey pipo dey tok about now na di fake nails and fake eyelashes wey Tanzania parliamentary speaker ban female Members of Parliament not to wear dem earlier dis week.
Amina Juma, wey dey stay for Dar es Salaam plus dey use fake nails and eyelashes, tell BBC say she neva experience any problem wit fixing fake nails and eyelash.
"I don dey use dem for years and I neva see any effect. I no go stop to dey fix dem.
"I dey feel more beautiful and dey confident wen I fix fake nails and lashes and my eyes go come dey fine well-well wit di fake lashes."
But Fredrick Mashini, wey be lecturer for Muhimbili University of Health and Allied Sciences, tok say di glue wey dem dey use for fake nails and lashes fit cause serious palava for some pipo bodi.
"Fake lashes dey thick and long so dem fit carry bacteria go di eyes" Mashini tok for im reaction
Some women wey agree say dem dey use fake nails, tok say dem dey more concern about fake eyelashes and no be di nails.

Di Speaker of Tanzanian Parliament, Job Ndugai bin give health risks as di reason for di ban wey go affect female MP and oda women wey wan visit di parliament from Monday 10 September.
End of Di one wey oda users dey read well well
Monica Shayo tell BBC Tori pesin say "I don dey put fake nails but I no go ever put fake lashes, I like di way my eyes dey well-well! I no go risk to put dis kain tin for my eyes, you no go fit compare nails wit my eyes."
One female Member of Parliament, Upendo Peneza tok say di ban go dey hard to implement.
"Dem wan begin dey check us wen we pass security check? E no make make sense. Di speaker for just advise us make we no use am for di sake of diplomacy."
"And e no go fit drag you comot from di building just because you fix fake nail or fake eyelashes''











