Ariana Grande fans no like di way Pastor hold her for bodi

Ariana Grande fans no like di way Pastor hold her

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Ariana Grande bin sing Aretha Franklin 'You Make Me Feel Like a Natural Woman' for di burial
Read am in 2 mins

Fans of American musician Ariana Grande scatta twitter on Saturday morning sake of di way one pastor hold her bodi after she perform for Aretha Franklin burial.

Bishop Charles H. Ellis wey lead Franklin burial greet Ariana for stage on Friday night afta she sing one Aretha song.

But fans begin para wen video wey pipo dey share for social media show say di pastor hand press di musician breast as im dey hold her.

Shaperly, her fans begin trend di hashtag #RespectAriana as dem post photos of di pastor as im hold her and how e dey vex dem.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Some of dem tok say di tin wey di pastor do na sexual assault while odas feel say di pastor overdo wit di way im hand travel go her bodi.

Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Afta some hours, Bishop Charles don comot to tell world pipo sorry as e say "no be im plan to touch any woman breast."

"Maybe I cross border, maybe I bin dey too friendly or familiar but again, I say sorry".

Even though many pipo don wire di preacher, Ariana Grande never tok anytin for media on top di matta.

See how fans dey para;

Skip X post, 3
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 3

Skip X post, 4

End of X post, 4