Davido: NYSC camp for Lagos scata as superstar musician show

Nigeria musician Davido cause kasala for camp

Wia dis foto come from, @iam_Davido/twitter

Wetin we call dis foto, NYSC post Davido go Lagos Camp
Read am in 1 mins

Nigeria musician Davido cause Nigeria Youth Service Corps (NYSC) for Lagos to scata wen im show di camp on Thursday.

Tori be say security officials no find am easy to control di fans wey rush to go take picture wit di musician.

Davido wey graduate from Babcock University for Ogun State wia im study Music dey among di 2152 batch of corps members wey take dia oath for NYSC Orientation Camp for Lagos.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Im tell tori pipo News Agency of Nigeria say e "be youth and im dey happy to serve im papa land."

NYSC na compulsory youth service wey graduates for Nigeria wey dey below 30 years must undergo.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post