NYSC: Davido, Falz, oda top Nigeria artiste wey don serve dia fada land

Read am in 2 mins

Nigeria music star David Adeleke Adedeji a.k.a. Davido dey trend for social media sake of say e enta camp to do di compulsory national youth service for di kontri.

Davido tweet picture wia im wear im NYSC khaki ontop im car.

NYSC Lagos camp also post di tori for dia Facebook page wia di music star dey register for dia Iyana Ipaja camp.

BBC Pidgin try to torchlight how many top Nigeria stars wey don follow serve dia fada land for NYSC.

Damilola Afolabi aka L.A.X.

Na Lagos born artiste wey school for Turkish International School, Lagos wia im form music group Flyboiz. Na dem release di song "Busy Body". E get master's degree from University of Manchester for United Kingdom. L.A.X feature Wizkid to release di song "Caro".

E serve im papa land for Lagos state for 2016 /2017.

Folarin Falana a.k.a. Falz

Falz na anoda Lagos boy wey im papa na popular Nigeria Lawyer Femi Falana.

E school for St. Leo's Catholic Primary School, Ikeja and Olashore International School, Osun State.

Falz graduate from University of Reading UK wia im study law like im papa.

Nigeria call am to bar for 2012 afta im graduate from Nigeria Law School, Abuja.

Na afta im produce di song "Marry Me" im become popular, im feature Poe and Yemi Alade for di song. Im be di oga pata pata for Bahd Guys Records.

E serve im papa land for Ministry of Justice Lagos state for 2011.

Bovi Ugboma a.k.a. Bovi

Bovi na Nigerian comedian wey dey use joke make im fans laugh.

Dem born am for Benin City, Edo state. E school for UNIBEN staff schools, come do secondary school for Ughelli Northern for Delta State. Later e study Theatre Arts for Delta State University

Na for 2003 e serve.

Nigeria get plenti music stars, but e be like plenti top Nigerian artiste no go school sef tok of to go do youth service.

Abi dem dey hide dia youth service status as BBC Pidgin no fit confam if dis oda top stars do youth service.

Plenti pipo plus top artiste dey congratulate Davido while odas dey yab am for social media.

Some say im be di richest corper ever to serve for NYSC.