You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Davido: 'I go expose people wey dey owe me money'
Nigerian singer Davido don threaten say im go publish di names of all di people wey dey owe am money for Lagos.
Dis na after one court paper show say Lagos state government bin accuse di singer say im no dey pay tax.
Na so di Afrobeats star take vex enter social media say im dey give im debtors till end of today before im go publish dia names.
Nigerian comedian Ayo Makun wey people sabi as AY na one of di people wey Lagos state government dey follow accuse as part of di people wey no dey pay tax.
Davido dey also ginger make dem release one of im crew members, Kayode wey dey inside prison.