Nigeria 2019 Election: 'Make PDP aspirant unite to sack Buhari' - Wike

Rivers State Governor Nyesom Wike yarn dis one on Thursday as 2019 election and campaign period don dey enta gear one.

Wia dis foto come from, River State Government

Wetin we call dis foto, Govnor Nyesom Wike and Alhaji Attahiru Bafarawa

Pipo wey wan stand for president under Nigeria main opposition People's Democratic Party - PDP suppose get one front to support anybody wey come out as di Presidential flag bearer so dat dem fit comot di All Progressives Congress APC for power.

Rivers State Govnor Nyesom Wike yarn dis one on Thursday as 2019 election and campaign period don dey enta gear one.

Na for Government House Port Harcourt, southern Nigeria wen one of di Presidential aspirant and former Govnor of Sokoto State, Attahiru Bafarawa come do condolence visit say sorry for di Rivers State Attorney General, Late Emmanuel Aguma wey die na im di govnor tok dis one.

Governor Wike say, "all of us must put our head together to remove dis goment wey no mean well for Nigerians. Power come from God so God say na you, nothin any man fit do about am, dem go only struggle."

Im come add say evri member for PDP must work as a team for di party to win for 2019.

'If Nigeria police no fit secure election for just eight wards, wetin go happun for 2019' - Wike

Ambassador to Nigeria, Ketil Karlson, Rivers State Govnor Nyesom Wike, Ambassador of Ireland to Nigeria Sean Hoy

Wia dis foto come from, River State Government

Wetin we call dis foto, Ambassador to Nigeria, Ketil Karlson, Rivers State Govnor Nyesom Wike, Ambassador of Ireland to Nigeria Sean Hoy.

European Union Ambassadors dey advise security pipo and oga dem wey get mouth for election mata inside di kontri say dem must make sure say wetin happen for Rivers Assembly by-election no happen for di general election wey go happen for 2019

Di Ambassador to Nigeria Ketil Karlson come praise INEC wey be di kontri election office as dem suspend di 18 August by-election for Port Harcourt sake of di katakata wey happun.

"Youths don show interest and wan vote and we must make di environment for dem to vote." Karlson tok.

Ambassador of Ireland to Nigeria Sean Hoy say make federal goment make sure say elections wey go hold for 2019 go respect di rule of law.

"We must always follow di rule of law because election without di rule of law no good, e no good for good governance."

Rivers state goment commissioner for information say make EFCC leave dem alone

Wia dis foto come from, Twitter/@Gov_Wike

Wetin we call dis foto, Govnor Nyesom Wike

Rivers State Govnor Nyesom Wike say e dey embarrassing say police no fit make sure say election hold for just 8 wards.

Di govnor begin wonder wetin go happen for di 4442 polling units. Im say pesin no pray say dat kain tin go repeat again because violence no dey help.

Oga Wike say, "I don tell di international community say we want free and fair elections. Anybodi wey see wetin happun on 18 August 2018 go know say if we bin react, e for worse. For us as goment and as pipo, we go continue to support free and fair elections