Army dey man polling station afta kasala bust for Rivers by-election

- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
Di by-elections for Rivers state, south-south Nigeria, don turn upside down afta violence for one of di polling stations for capital Port Harcourt.
BBC tori persin Karina Igonikon dey ground for constituency wey dey Mile 1 Diobu as some pipo try to snatch ballot box.
Na so security pipo begin shoot gun and tear gas to scatter dem.
Di by-election dey hold for only 8 wards and four political parties dey follow drag di election.






