Nigeria Civil War: Abonnema for Rivers state dey mark 50 years freedom from Biafra
- Author, Karina Igonikon
- Role, BBC News Pidgin, Port Harcourt
21 June 1968 na date pipo for Nyemoni community alias Abonnema for Rivers state, south south Nigeria no go quick quick forget.
Dis na sake of say for dis day, 50 years ago, Biafra soldiers cari force enta di community to drag pipo comot go live for Igboland, south east Nigeria.
Tori be say dem march evribodi for di town to di Niger dock river so dem go enta boat wey go carri dem comot.
Di Biafra soldiers also arrest King Davies Bobmanuel wey be Abonnema traditional ruler for dat time.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di King bin beg di soldiers say instead make dem comot im pipo for dia land, make dem carri only am go but di soldiers no wan hear.
But around 12 o clock for afternoon, u-turn happun as Nigeria soldiers enta Abonnema wit mission to fight di Biafrans and help Abonnema pipo.
Na from Buguma community di Nigerian fighters bin take enta Abonnema and e no tey before dem pursue di Biafra soldiers comot, come free di town.

From dat time, 21 June don turn special day for Abonnema to mark dia 'freedom' for di hand of Biafran soldiers during di Nigeria civil war.
End of Di one wey oda users dey read well well
E normal to see many pipo for di town to dey wear costume wey include army uniform and to act di tins wey happun for 1968.
Dis ceremony wey dem name, 'Go to Niger' na for evri year dem dey do am and na time to jollificate.

Wia dis foto come from, Getty Images
Di Amanyanabo of Abonnema, King Disrael Gbobo Bobmanuel tell BBC Pidgin say dis year go mark 50 years wey dis tin happun and dem dey take di celebration to tell di young pipo wey no dey dat time wetin happun so dem no go forget wetin God di for dem.
Im say, "We dey prayerful and dey tell di younger generation di tori wey happun for dat time make dem dey peaceful and prayerful".
For dis Biafra tok wey di King hala, im still say, "Abonnema no be part of Biafra. We believe in One Nigeria so we no get any reason to want make Nigeria separate.''
''We wey be traditional rulers wetin we want na for our community to dey peaceful and to progress."













