Pogba brother: German club reject Mathias to play for dem sake of e too fat

Mathias Pogba

Wia dis foto come from, Getty Images

German third tier side KFC Uerdingen don reject France World cup winner Paul Pogba brother, Mathias Pogba because e too fat.

Di 27 year old Guinea born wey don play for Wrexam, Crewe Alexandra, Crawley Town, Seria B side Pescara bin dey on trial for di club to continue e football career dis season, according to local tori pipo Bild.

Dat dream no go go through for Uerdingen now after coach Stefan Kramer think say even though e get good qualities, e need to lose weight.

"Mathias no for fit epp di team, e don go again. Currently e no dey physically fit, im get good physique to be number 9 but e still get too many kilos for im hips." Na so di 51 year old Kramer tok.

Paul Pogba and e brothers Mathias and Florentin

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Mathias and e twin Florentin follow dia brother Paul Pogba kiss di world cup after France win am for Russia 2018

Mathias dey play senior professional football for im kontri Guinea. E last play as striker for Sparta Rotterdam for di Eredivisie, Netherlands.

Mathias twin brother Florentin Pogba dey play for St.Etienne inside di French league.