Krispy Kreme: NAFDAC and CPC don shut down new Lagos doughnut shop sake of expired product

Front of Krispy Kreme shop

Wia dis foto come from, Consumers Council NG

Read am in 1 mins

Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) and Consumer Protection Council (CPC) don close down Krispy Kreme shop for Lagos, Nigeria.

Oga of CPC, Babatunde Irukera post for social media say dem don march brake on top Krispy Kreme operation and close di store wia dem dey keep ingredients because dem dey use products wey don expire.

Di mata happun on Wednesday wen CPC and NAFDAC go do inspection for di Victoria Island branch of Krispy Kreme.

Skip X post, 1
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 1

Door of shop wey dem don close down

Wia dis foto come from, Consumers Council NG

Wetin we call dis foto, CPC dey always do random inspection into company dem wey dey sell products to public
Skip X post, 2
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post, 2

Krispy Kreme na US-based company wey dey sell doughnuts and dem just open dia first shop for Nigeria dis year - South Africa na di only oda kontri dem dey for Africa.

Di company also get anoda shop inside Ikeja City Mall.

BBC Pidgin contact Krispy Kreme and one staff Akin wey follow us tok say im believe say e no go tay before di shop open again.

Products wey show date wey don expire as di time CPC do inspection

Wia dis foto come from, Consumer Council NG