Elections Cameroon don komot list for candidates for 2018 presidential elections

Wia dis foto come from, ISSOUF SANOGO
Elections Cameroon, Elecam weh e di organise elections don follow calendar, komot list for nine candidates weh de go run for 2018 presidential elections and woman no dey.
Elections Cameroon shifter de files for 28 candidates weh deh di langa pawa and announce nine weh deh go run for 2018 presidential elections.
One candidate, Isaac Fezeu bi go back komot e file and na 27 files weh Elecam examine, accept nine reject 18 and de candidates get 48 hours for petition constitutional council.
Cabral Libih, for Univers party, weh e dey among de nine candidates, tell tori pipo say na privilege for yi for tanap as candidate for pipo weh deh contribute dia moni for pay de FCFA30 million caution.
"Ah di call de oda eight candidates make we komot strategy for dis election and ah di support unique candidate for challenge de candidate for pawa, Paul Biya" e tok.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1

End of X post, 2
Paul Mahel weh e represent Akere Muna tok say e bi satisfied as dia candidate deh for list.
"We dey for starting block for show weti we go do, we go continue with campaign, present we project and mobilise population. Akere Muna di tok with odas for see if coalition for opposition parties go komot."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 3
We candidate, na old candidate, with experience and plenti na new pipo weh deh di just come, first taimers and ah trust say deh no get match for Paul e side, Jean de Dieu Momo weh e gada opposition parties for support ruling party, CPDM, tok.
End of Di one wey oda users dey read well well