Imo Deputy Governor: Court bounce Callistus Ekenze swearing-in as Eze Madumere chop impeachment

Eze Madumeres

Wia dis foto come from, Facebook

Wetin we call dis foto, Eze Madumere get accuse of gross negligence

High Court for Owerri Imo state capital south east Nigeria don sama interim order to stop di swear-in of di new deputy govnor Callistus Ekenze.

Plenti pipo bin gather for Sam Mbakwe Exco Chamber inside Imo Government House Owerri dey wait for di swearing in ceremony, but di state Attorney General and Commissioner for Justice Miletus Nlemadim waka enta di hall to tell pipo wey gather say court don stop di swearing in.

Chief Press secretary to Imo state governor Sam Onwuemeodo tok say Governor Rochas Okorocha bin giv directive make dem obey court order to stop di swearing-in.

Wahala land di domot of Eze Madumere di Deputy Governor of Imo State eastern Nigeria as lawmakers for di State House of Assembly vote on Monday to impeach and replace am sharp sharp wit foma Head of Service Calistus Okenze.

Court order come for Monday morning say make lawmakers no comot Mr Madumere but dem no listen.

Di impeachment bin come afta 19 out of di 27 members of assembly vote against am say im disappear for office for three months without reason among oda issues.

Di lawmakers no look Imo State High Court face wey bin hold dem hand until dem don settle mata wey dey court.