Ortom: Na Buhari dey use lawmakers 'impeach' Benue governor - Spokesman

Samuel Ortom

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Tori wey dey gain ground na how lawmakers for di central Nigerian state of Benue don send 'impeachment notice' give di governor, Samuel Ortom.

Na eight lawmakers gada for di state house of assembly to impeach di governor.

But di spokesman of di govnor, Mr. Terver Akase tell BBC News Pidgin say na President Muhammadu Buhari and di federal goment dey remote control di state lawmakers.

E say na police and security agencies cari di lawmakers go di House of Assembly for wia dem impeach di govnor and dem no give di oda 22 lawmakers chance to enter.

Akase tok say, ''Dis seven lawmakers plus di former speaker wey dem impeach before, na dem nack di govnor wit impeachment letter, come give deadline of seven days to follow dia action''.

Dis na some of di honorables on Tuesday afternoon inside di House of Representatives
Wetin we call dis foto, On Tuesday 24 July, 38 House of Representatives members run leave ruling ALL Progressives Congress

Akase add put say na Nigeria President Muhammadu Buhari dey control di police and security pipo unto say na only im get di kain power.

Akase tok say, ''Na di Federal Goment under di All Progressive Party wey President Buhari dey in charge dey behind dis action.''

''Dem wan cause political katakata to make di state hot for guvnor Ortom to handle.''

''Dem no happi say govnor Ortom don comot for di party [last week].''

Im still say wetin dis eight lawmakers dey do no follow law unto say na at least ten lawmakers suppose impeach sitting govnor.

Wetin we call dis Video, APC mass defection: 'Maybe rice price go reduce'

BBC Pidgin dey try follow presidency tok dia own on top di mata but Femi Adeshina, di Special Adviser for Media and Publicity tok say dem no get any comment for now.

President Buhari no dey kontri as e dey visit Togo wia im don yan say e no too bother as some politicians don leave im party.