Ekiti election materials don reach all di 16 local goment areas - INEC

Ekiti election preparation dey gear three as Independent National Electoral Commission (INEC) wey go organize di election don begin distribute materials for Saturday 14 July govnorship vote.
Dis na afta INEC collect election materials from Central Bank office inside Ado Ekiti, di state capital, on Thursday.

'We don distribrute all di materials to all di local goments, all di party agents dey confam say evritin complete before we begin share dem. I get five Supervisig Resident Electoral Commissioners (RECs) wey dem send to come assit me and four National Commissioners.'
Na wetin Ekiti State Resident Electoral Commissioner Professor Abduganiyu Raji tell BBC.
Content is not available
View content on FacebookDe external site no concern BBC.End of Facebook post

Wia dis foto come from, OfficialPDPNig
If Ekiti State election get k-leg, Nigeria democracy don dabaru - PDP
Meanwhile, members of main opposition Peoples' Democratic Party PDP don do I no go gree waka for across Nigeria.
For Abuja, Nigeria capital, na di National Chairman of di party, Uche Secondus and oda national leaders of di party lead di protest.
Dem di para on top how Police pipo for Ekiti State for south-west Nigeria block di goment house for di state, come disrupt PDP rally on Wednesday.
End of Di one wey oda users dey read well well
Governor Ayodele Fayose bin announce for local tori pipo say, di police pipo beat am and pour am tear gas.
Di PDP leadership say di way wey dem treat Fayose, na civilian coup and say if INEC venture rig di election, kasala go dey.
Dem begin di protest from dia secretariat and dia first point of call na di National Assembly, wey dem carry dia cry go.
Afta dem read dia petition, di deputy Senate President, Ike Ekweremadu come assure dem say di lawmakers chook eye on top dia mata.
From National Assembly dem arrive for INEC and cut warning give di election bodi say if di election get k-leg, e den mean say Nigeria democracy don dabaru.










