#NigerianLivesMatter: Police no allow pipo wey dey protest see Buhari
Nigerians enta road for di capital, Abuja to protest against goment on top all di kill-kill wey dey happun for di kontri.
For early mor-mor, many pipo wear black, cari placard dey march from Unity Fountain, pass Ministry of Justice go Eagle Square.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Different hashtags like #NigerianLivesMatter, #NigeriansStandUp and #EnoughIsEnough don full Twitter.

Wia dis foto come from, Maureen Kabrik
Amnesty International bin accuse Nigeria goment say because dem no do wetin dem suppose do to protect Nigerians, 1,813 pipo don die for different kasala between farmers and herdsmen for 17 states.
Many pipo don follow join di protest and dem dey share am for social media.
How police pipo prevent protesters to see Buhari
Di police officers wey dey stationed for di entrance to di presidential villa no allow Nigerians wey dey do I no go gree on top killi-killi for di kontri to see di president.
Di protesters bin do peaceful march from di popular unity fountain to di presidential villa but as dem reach di entrance na so police pipo stop dem.
Di protesters come siddon for ground and one afta di oda dem ginger dem self and afta dat dem come di sing dey try force demselves pass di police.
End of Di one wey oda users dey read well well
Before you know, oda police pipo come gada wit tear gas but las -las, di protesters come warn say dem go come back on di 11th of dis month
Di forma chairman of Human Right commission, Chidi Odinkalu say dem choose today because dem know say Wednesday na FEC meeting and dem believe say na di right time to see di president to tell am wetin dey dia mind.
E explain give say thousands of pipo dey die everyday for di kontri and e be like say di president no fit do anything.
Dis no be di first time wey protest like dis dey happun for Nigeria capital.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2

End of X post, 3
E no tay wey some pipo arrange one #BloodOnTheFlag movement to send strong message to goment on top di same mata.
Di organizer, Niyi Akinmolayan wey be film maker, tell BBC Pidgin say im ginger celebrities for entertainment industry to share foto of demself for social media with fake blood to show support to di family of pipo wey don die.
Nigeria Senate bin tok say di senior legislative house wan look weda to change di constitution to give states dia own police.
Senate President Bukola Saraki cari di mata enta Twitter as e dey put mouth for all di kill-kill wey dey happun for di kontri.
Oga Saraki say dem don tell goment say dem suppose look as security be for di kontri and dem suppose re-arrange tins so di kill-kill go stop.
"We as Senate, suppose do our own action, we no need to dey drag di mata.''
''We don tell di presidency wetin dem suppose do. We don tell dem for private, we don tell dem for public. For us o, we suppose decide on wetin we wan do."
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 4
Osai Ojigho, Director Amnesty International Nigeria, say "di job of authorities na to protect lives and property, but e be like say wetin dem dey do no reach as we dey see wetin dey happun so."
She say di latest one wey happun for Plateau state kill 200 pipo for 11 villages.