Plateau state attack: Police don confam at least 86 pipo die for wetin fit be herdsmen attack

Plateau women dey protest for Jos

Wia dis foto come from, PIUS UTOMI EKPEI

Wetin we call dis foto, Thousands of women dey protest for Jos on top di plenty attacks wey dey happen for Plateau state, 2010
Read am in 3 mins

86 pipo na im police don confam say die for attacks wey happun for about 11 communities for Plateau State, north-central Nigeria.

Police for di state bin say na 11 pipo die, but later on Sunday evening police tok-tok pesin for Plateau State, Matthias Tyopev, release statement wia im say di attack for communities wey dey inside Barkin Ladi Local Government Area on Saturday night don reach 86. Im say six pipo injure, dem burn 50 houses, 15 motorcycles and two moto.

President Muhammadu Buhari enta twitter to condemn wetin happun.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Tori be say di kasala begin for Thursday wen one group of herdsmen suffer attack and kill five of dem, na dis ginger revenge attack for Saturday afternoon wey kill even more pipo.

Pipo wey dey ground dey claim say wetin dia eye don see pass dis official number well well.

Goment don order night to morning curfew for Riyom, Barkin Ladi and Jos South local goment areas.

Rufus Bature, wey be senior official for di state goment, tok say movement na from 6pm to 6am except for very important waka.

Map of Plateau State
Wetin we call dis foto, Plateau state dey north-central Nigeria

Barkin Ladi, wey be nebor to Jos, Plateau state capital don become battleground for fight fight between farmers and herdsmen for up to 10 years now.

Barkin Ladi don enjoy on and off peace dis past two years but for last April, di worst gbege for many years happun.

Dis kain farmer and herdsmen palava don increase for di north central region for Nigeria since di beginning of 2018.

States like Benue, Nassarawa, Taraba, Kaduna and including Plateau don suffer attack afta attack almost month afta month.

Jos attack

Wia dis foto come from, AFP

Why security mata dey always disturb Plateau?

Tension and attack-after-attack don follow di people of Plateau state tey-tey.

Plateau na state wey Christians and Moslems dey live side by side for many many years.

Who dey in charge of tins like land and water for Plateau na one reason wey fit dey cause dis attacks.

Northern Nigeria na dry place for wia sand from Sahara full ground. Dis dey drive herdsmen, wey be mostly Moslems, comot for north waka enta southern states.

Primary Sv

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Sabon layi Primary School Camp wey burn for Jos, Plateau State for 2010.

Christian villages wey get farm, dey complain say di animals wey di cattlemen dey move wit, dey spoil dia land and affect how dia crops dey grow.

Anotha palava na say di farmers wey get land dey see herdsmen as 'visitors' even if di herdsmen don live for dia areas for plenti years.

Fulani leaders dey talk say state goment no dey treat dem well. Dem claim say tin like land, education and even goment job no dey reach dem.

Tensions dey reach level sotey dem don kill more than 10,000 people for di state since di year 2000 alone according to one group wey dey monitor security mata for dia.