Public holiday dey come as goment don declare June 15 and 18 for Eid-el Fitr jolli jolli

Celebrations in Nigeria

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Wetin we call dis foto, Many pipo miss out on June 12 as only south-west states declare holiday

Nigeria goment don declare public holiday for Friday, June 15 and Monday, June 18 to celebrate dis year Eid- El Fitr.

Permanent secretary for di interior ministry, cari dis message from Interior Minister Gen. Abdulrahman Dambazau (rtd.) give tori pipo for Abuja, Nigeria capital on Monday.

Dambazau jollificate wit Moslems unto di way dem finish di Ramadan fast ten over ten.

Im advice Nigerians make dem use dis jolli jolli time to pray for 'peace, unity, prosperity and stability' for di kontri.

Osogbo, Osun state

Wia dis foto come from, AFP/Getty Images

Dambazau tok say na di wish of goment make all Nigerians dey ginger unto di ogbonge tins di Holy Month of Ramadan don bring wey go make dem live life wey go boku wit 'sacrifice, charity and love'.

Im advice all Nigerians make dem follow join President Muhammadu Buhari sake of say im goment go cari di kontri go far.

Di minister wish all Nigerians Eid -El Fitr wey go boku wit peace and jollificate.