Joshua Dariye go stay inside prison self contain for 14 years

Wia dis foto come from, EFCC
Court don give former govnor for plateau state Joshua Dariye self contain for prison where im go stay for 14 years.
Justice Adebukola Banjoko of Abuja High Court on Tuesday find Senator Dariye gility for criminal breach of trust andusing public funds anyhow.
EFCC lawyer Rotimi Jacobs thank di judge as im complete di trial wey start since 2007.
Joshua Dariye lawyer beg di judge say wen dis offence happen for 2001 im client been no understand di 1999 constitution.
Im say di former govnor na victim becos na bank deceive am.
Di lawyer also also tok say to appeal against Justice Adebukola Banjoko judgement no dey always succeed.
Nigeria corruption police, Economic and Financial Crimes Commission, EFCC na im carry di mata go court.
Di mata don stay court for more than 10 years before judgement land for 12 June, 2018.
End of Di one wey oda users dey read well well










