Jolly Nyame: Nigeria former govnor don chop 28 years prison sentence

Wia dis foto come from, EFCC
One former govnor for north central Nigeria don chop court sentence to go sidon for prison for 28 years.
Na High Court for Abuja find Jolly Nyame, wey be former govnor of Taraba State guilty to spend 14 years inside prison for criminal breach of trust, anoda two years for criminal misappropriation, seven years for gratification and five years for wayo.
Nyame, court case begin July 13, 2007 for Federal Capital Territory, High Court, Guru, wit 41 count charge wey Nigeria corruption police, Economic and Financial Crimes Commission, EFCC knack for im head.
Tori be say Justice Adebukola Banjoko wey judge di mata rule say di former govnor dey guilty for 29 charges.
Justice Banjoko rule say Nyame wey even be Christian pastor, tif pipo trust wen e be govnor of Taraba, wen e play wayo and wuruwuru wit goment moni wey reach 250 million Naira.
Na Economic and Financial Crimes Commission, EFCC cari di mata go court.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 1
Justice Adebukola Banjoko wey sidon on top di mata also find Nyame guilty say e play wayo wit anoda 165 million Naira, according to wetin EFCC post for Twitter.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post, 2
Under President Buhari goment, dis na di first former govnor EFCC go send go jail.
End of Di one wey oda users dey read well well

Wia dis foto come from, Facebook - Rev. Jolly T. Nyame
63 year old Nyame fit stay reach 91 years if e no appeal di mata for Supreme court.











