Nigeria: No life assurance, rescue workers dey provoke

Dem dey vex on top condition of work
Wetin we call dis foto, NEMA workers bin carry placard, dey sing aluta song as dem gada for dia headquarters for Nigeria capital Abuja.

Nigeria fit suffer if nature strike today wit wahala alias natural disaster because goment rescue workers no happy to dia work.

National Emergency Management Agency workers do we no go gree waka on Monday close down dia office all ova di kontri on top provoke say dem dey work without Life assurance.

Dem say e don pass eight months wey dem dey beg dia Director General Mustapha Maihaja make e chook eye for Life assurance for staff but im no do anything.

" Some of our staff die wen our assurance expire and now dia family dem dey eat from hand to mouth. Some of dem na our office pipo here dey donate moni give dem to take chop", one of di protesters tell BBC pidgin.

Oga Maihaja imself neva reply di accuse and complain wey full ground. BBC Pidgin try to tok to am but im staff say di NEMA Director General dey Russia for di world cup.

E neva answer call to im phone number or reply text message we tori pesin send am on top dis mata.

Meanwhile NEMA authority say some of di demand of Nigeria rescue workers don already dey table for approval.

Di workers say dey DG dey dodge di mata
Wetin we call dis foto, Dey minister of Labour Chris Ngige sef don chook mouth for di mata

Di agency for statement say all di di life Assurance policy wey di worker dey talk about don already dey approved.

E say even dey new condition of service remain small make make dem approve as NEMA governing body don stamp am.

Di statement say di strike wey dey staff go dey illegal and e dey against Nigeria labour law and wetin dey union dey do na to frustrate di present goment.

Dem want goment to put mouth
Wetin we call dis foto, Di workers say dem no go open office until dey DG chook eye for dia mata

But di workers say since Mustapha Maihaja enta office, e no gree renew dia life assurance policy even though staff dey die for dia work for Borno, Yobe and Adamawa state.

Aside say dem no get life assurance, dem say dey DG no dey provide dem with wetin dem go carry work.