Trump Kim summit: Wetin America, North Korea want from each kontri?

Pesin wey dress like US President Donald Trump impersonator Dennis (L) and Pesin wey dress like North Korean leader Kim Jong-un impersonator Howard (C-R) take photo for Singapore Flyer and Marina Bay as dem pose for photographers inside Singapore, 08 June 2018

Wia dis foto come from, EPA

Wetin we call dis foto, Two pipo wey dress like Donald Trump and Kim Jung Un enta street days before di summit
Read am in 1 mins

America Presido Donald Trump land for Singapore on Sunday to attend di ogbonge meeting wit North Korean leader Kim Jong Un wey dem go use tok about di future of Pyongyang nuclear weapon.

Presido Trump fly enta Singapore Paya Lebar Air Base wit Air Force One Sunday afternoon, wit di hope to lay di groundwork for nuclear deal wit one of America most bitter long-time enemy.

North Korean leader Kim Jong-un first land for Singapore for im meeting with Donald Trump.

Wetin each kontri want?

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

US want make North Korea stop dia nuclear weapon patapata wey be say everibod fit see am korokoro. Defence Secretary Jim Mattis say na only wen dem begin do am dem go get "mercy" from all di UN punishment wey dey dia head.

But dis no mean say US dey expect final deal for Singapore. President Trump describe am as "time-to-know-you situation" and say: "E go be process."

Sabi pipo say as Kim don already get meeting wit di most powerful leader for di world, im don already win. Dem dey also ask why im go stop im nuclear weapons afta im don try well-well to get dem.

G7 meeting

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, Before im leave for Singapore, Trump bin attend di G7 meeting for Canada

Some pipo say im no go ever do am, unless everibodi wey dey for di Korean peninsula stop dia own too - including US.