Trump Kim summit: Trump, Kim don land Singapore for June 12 meeting

Kim

Wia dis foto come from, Handout

Wetin we call dis foto, Trump go land later on Sunday

America Presido Donald Trump land for Singapore on Sunday to attend di ogbonge meeting wit North Korean leader Kim Jong Un wey dem go use tok about di future of Pyongyang nuclear weapon.

Presido Trump fly enta Singapore Paya Lebar Air Base wit Air Force One Sunday afternoon, wit di hope to lay di groundwork for nuclear deal wit one of America most bitter long-time enemy.

North Korean leader Kim Jong-un first land for Singapore for im meeting with Donald Trump.

Di ogbonge meeting between di two leaders go take place for one island of Sentosa on Tuesday June 12.

Dis na di first time North Korean leader dey meet wit sitting US president.

A vehicle thought to be carrying Kim Jong-un drives through Singapore

Wia dis foto come from, Reuters

Wetin we call dis foto, A vehicle thought to be carrying Kim Jong-un drives through Singapore

Before im begin go di meeting, President Trump describe am as "one chance" for peace and say di two of dem dey for wia "dem neva dey before true-true".

Washington dey hope say di meeting go start process wey go see oga Kim give up im nuclear weapons.

Before im begin go di meeting, President Trump describe am as "one chance" for peace and say di two of dem dey for wia "dem neva dey before true-true".