You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
'No public holiday for June 12' - Nigeria goment
Read am in 1 mins
Nigeria Federal Goment don announce say public holiday no go dey for June 12, 2018.
Before now pipo bin dey tink say goment go declare di day as public holiday as e be say president Muhammadu Buhari announce am to be di new day to celebrate Democracy.
For di twitter handle of Nigeria goment, @asorock di presidency explain say di new date to celebrate democracy go begin "in future years" and go replace May 29th as a National Public Holiday.
Dis tweet help answer di kwesion wey plenti Nigerians don dey ask questions about June 12, 2018.