'No public holiday for June 12' - Nigeria goment

President Muhammadu Buhari declare June 12 as Democracy day for Nigeria to take honour late chief M.K.O Abiola

Wia dis foto come from, Getty Images

Wetin we call dis foto, President Muhammadu Buhari declare June 12 as Democracy day for Nigeria to take honour late chief M.K.O Abiola
Read am in 1 mins

Nigeria Federal Goment don announce say public holiday no go dey for June 12, 2018.

Before now pipo bin dey tink say goment go declare di day as public holiday as e be say president Muhammadu Buhari announce am to be di new day to celebrate Democracy.

For di twitter handle of Nigeria goment, @asorock di presidency explain say di new date to celebrate democracy go begin "in future years" and go replace May 29th as a National Public Holiday.

Skip X post
Allow X content?

Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of X post

Dis tweet help answer di kwesion wey plenti Nigerians don dey ask questions about June 12, 2018.