Senate President Bukola Saraki: Police say make I no appear for station again

Wia dis foto come from, @BUKOLASARAKI
Senate President Bukola Saraki say Nigeria Police don write am letter, say make im respond to accuse say im get hand for Offa robbery for Kwara State, wia 33 pipo die.
Dr Saraki wey tok dis one for im twitter account, say police no want am to appear for station again, and say im go respond to dem in writing within 48 hours.
Dis article contain content wey X provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di X cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.
End of X post
On Sunday, Nigeria Police bin accuse di Senate President and di govnor of Kwara State, Abdulfatah Ahmed say dem sponsor thugs we bin cari out armed robbery for April wia some policemen also die.








