Offa robbery: Nigeria Police say Bukola Saraki and Kwara State Govnor get hand for incident wey kill 33 pipo

Police

Wia dis foto come from, Nigeria Police

Wetin we call dis foto, Police show tori pipo di suspects dem don arrest

Nigeria Senate President Dr Bukola Saraki and Kwara State Govnor, Abdulfatah Ahmed, don deny Nigeria police accusation say dia hand follow for di Offa robbery wey happen for April dis year, wey police say kill 33 pipo.

Nigeria Police bin release statement on Sunday say di five gang leaders and some of di oda 17 suspects wey dem arrest ontop di robbery, confess and give statements say dem be political thugs of Senate President Dr Bukola Saraki and Kwara State Govnor Alhaji Abdulfatah Ahmed.

Yusuph Olaniyonu wey be Special Adviser (Media and Publicity) to di Senate President release statement wia im say police wan embarrass am (Saraki) and say for Police IG mind, dis na im own response afta im refuse to honour di invitation by National Assembly to come explain di killi-killi wey dey happen across di kontri.

"Like di earlier one, dis frame-up go also fail as I hereby state hoha say I no get link with any band of criminals," im tok.

Bukola Saraki

Wia dis foto come from, @bukolasaraki

Wetin we call dis foto, Police say dem don invite di Senate President to come ansa kwesion

For statement wey di Senior Special Assistant on Media and Communication to di Kwara State govnor, Dr Muyideen Akorede release, im say wetin Nigeria police or di armed robbery suspects wey dey dia hand tok na lie.

"To set di records straight, di Kwara State goment get empowerment scheme under di Small And Medium Enterprises platform wey dem dey use to move women and youths groups into entrepreneurship. Many youth and women groups don benefit from am... if any of di beneficiaries chose to use di SME credit wey dem get from goment to buy car wey dem use comit crime, you no go fit hold di govnor and indeed di state goment for trouser," im talk.

Dr Akorede confam to BBC say na true say two of di govnor assistants dey police hand, but im say na invite dem invite dem. Im also deny wen we ask am, say police no see any moto for goment house, as police bin tok for dia own statement.

Police

Wia dis foto come from, Nigeria Police

Wetin we call dis foto, Police show tori pipo di suspects dem don arrest

Di robbery bin happen on 5 April 2018 for Kwara State, northcentral Nigeria, and police say na 33 pipo bin die and say dem thief millions of naira from banks and cari 21 AK47 police guns.

Di police statement say: "Di five gang leaders confess during investigation say dem be political thugs under di name Youth Liberation Movement a.k.a "Good Boys" and say na di Senate President, Sen. Bukola Saraki and di Govnor of Kwara State, Alh. Abdulfatah Ahmed sponsor dem".

Dem say as dem dey do dia investigation to check wetin di suspects tok, say dem trace one moto wey cari sticker plate number wey dem write "SARAKI" "Kwara, State of Harmony" to goment house for Ilorin wia dem change di sticker.

Lexus car

Wia dis foto come from, Nigeria Police

Wetin we call dis foto, Dis moto don land two assistants of di Kwara State govnor for police hand

Police say dem don arrest two assistants of di govnor - Alabi Olalekan and Yusuf Abdulwahab say dem hand dey inside dis moto wey dem change number plate.