You’re viewing a text-only version of this website that uses less data. View the main version of the website including all images and videos.
Real Madrid vs Liverpool: Gareth Bale finish work for Madrid to win di Champions League final
Gareth Bale overhead kick finish work for Real Madrid to win di Champions League final.
Afta dem carry penalty win Atlético Madrid for 2016, Wound Juventus 4-1 in 2017, Real Madrid wey be Spain team beat Liverpool, 3-1, on Saturday night to win the UEFA Champions League.
Dis go make am three times back to back, four times inside five years, and total of 13 times wey Marid don carry di cup.
Zinedine Zidane team sore di first and last goal for di match.
Di man wey plenti Liverpool fans take get hope, Mo Salah bin wound for first half so e no fit play di match finish.
For Liverpool manager Jurgen Klopp, na disappointment again - e lose im third final match back to back since im become oga for Anfield, on say dem beat im club even for di League Cup and Europa League finals of 2016.