Gunmen attack Nigeria Airforce base, kill one for Bayelsa

Nigeria Airforce

Wia dis foto come from, AFP

Read am in 1 mins

Gunmen kill one of dia men for dia helicopter landing site for Yenagoa, Bayelsa state capital for Sunday.

According to wetin Nigeria Air Force (NAF) talk, Air force men wey dey ground engage di unknown gunmen, wey break enta di base launch attack, fire for fire.

Olatokunbo Adesanya, wey be NAF talk talk pesin, tell tori pipo say, ''For early mor mor Sunday, 13 May 2018, one group of unknown gunmen attack di guard post for Nigerian Air Force Helipad for Igbodene, Yenagoa, Bayelsa state''.

''Di NAF men wey dey duty battle di attackers till dem drive dem comot but one airman no survive di attack''.

Dis na di only tin di Airforce gree talk.

Skip Instagram post
Allow Instagram content?

Dis article contain content wey Instagram provide. We ask for una permission before anytin dey loaded, as dem fit dey use cookies and oda technologies. You fit wan read di Instagram cookie policy and privacy policy before accepting. To view dis content choose 'accept and continue'.

Warning: Third party content may contain adverts

End of Instagram post

Meanwhile pipo wey see di action live wit dia ow two eye, talk say di gunmen wound some of di Airforce men and even cari some of dia weapons waka.

Sabi pipo dey talk say dis attack fit be sign of fresh attack wey don dey trouble for di oil rich Niger Delta region tey tey and e fit affect oil production and Nigeria economy wey dey shake.