‘Federal Gofment, investigate Rivers State Judiciary destruction’ - Gov Wike

River state governor-Nyesom Wike say make federal goment come investigate di destruction wey happen for di state judiciary complex.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook

Wetin we call dis foto, River state governor-Nyesom Wike say make federal goment come investigate di destruction wey happen for di state judiciary complex.

Rivers State Governor Nyesom Wike don ask Nigeria goment to chook eye and investigate wetin make APC (All Progressives Congress) political party pipo spoil plenti tins for di state judiciary complex on Friday May 11, 2018

Di governor tok dis afta im go use eye to check all di tin wey destroy for di judiciary complex.

Im say make di investigation bring out all di pipo wey dey responsible and make sure say dem face justice.

Governor for Rivers State carri waka go see tins wey scatter during di gbege.

Wia dis foto come from, AFP

Wetin we call dis foto, Governor for Rivers State carri waka go see tins wey scatter during di gbege.
Rivers state governor say make di investigation on top di mata bring out pipo wey dey responsible.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook

Wetin we call dis foto, Rivers state governor say make di investigation on top di mata bring out pipo wey dey responsible.
Plenti tins for di state judiciary complex spoil for di gbege wey happen on Friday May 11.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook

Wetin we call dis foto, Plenti tins for di state judiciary complex spoil for di gbege wey happen on Friday May 11.
Plenti tins for di state judiciary complex spoil for di gbege wey happen on Friday May 11.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook

Wetin we call dis foto, Plenti tins for di state judiciary complex spoil for di gbege wey happen on Friday May 11.

Tori be say one faction of di APC for di state wey loyal to Minister of Transportation Chibuike Rotimi Amaechi wey be di leader of di party for di state bin go block di gate of di judiciary complex, so dat anoda faction of APC wey loyal to Senator Magnus Abe wey dey represent Rivers South East no go get court order to stop di APC local goment Congress wey suppose hold on Saturday May 12, 2018.

Di tin come tie wrapper as di two factions come meet begin destroy buildings for di judiciary complex plus car dem wey dem park inside.

Security pipo from Federal Special Anti-Robbery Squad F-SARS and operatives from Department of State Security (DSS) come shoot gun for air and open tear gas to drive di protest pipo comot.

Security pipo shoot gun for air and open tear gas to drive di protest pipo comot.

Wia dis foto come from, Rivers State Government House/Facebook

Wetin we call dis foto, Security pipo shoot gun for air and open tear gas to drive di protest pipo comot.

Afta evri evri, di court come siddon and Justice Chiwendu Nworgu of Rivers State High court come give interlocutory injunction to stop di APC make dem conduct di local goment Congress.